More dan 30 pipo fit don kpai afta one military aircraft crash for Igbokoda, di headquarters of Ilaje local govment area of Ondo State, southwest Nigeria. Police tok say di crash don cause panic for di coastal community. Authorities don deploy emergency and security teams go di area.
Nigerian Ministry of Aviation and Aerospace Development don confam di plane crash. Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, for statement tok say im regret to inform di general public say Air Traffic Controllers don inform am of di disappearance of military aircraft wit tail number NGR 931. Di aircraft dey go Lagos from Benin at 0913 hours earlier today. All efforts to raise di aircraft on radio proved abortive.
Keyamo add say na afta dem no fit radio di aircraft na im dem confam say e don crash. ‘Subsequently information however confam say di military aircraft don crash close to di Naval Base for Igbokoda, Ondo State. Dem don locate di wreckage and search and rescue operations dey go on,’ im tok. According to di minister, preliminary information suggest say na 25 passengers and 7 crew members dey on board di aircraft.
Im add say even though di control and regulation of military aircraft dey completely outside di authority of di Ministry of Aviation and Civil Aviation Authority, di Chief of Air Staff, Air Marshal Sunday Kelvin Aneke, don pledge total cooperation and assistance for di search and rescue efforts wey dey go on.
Earlier, one resident, Olorunlola Oluwafemi, bin tell BBC say rain bin dey fall wen residents hear ‘one loud sound like thunder’. Afta dem realise say no be thunder, e say: ‘We come outside and discover say na sometin wey look like jet.’ E say smoke bin dey rise from di area wia di aircraft crash. According to Mr Oluwafemi, di aircraft crash near one forest close to one naval base wey dem know as Forward Operating Base (FOB) for Igbokoda.
Anoda eyewitness, Asogbon Alexander, bin tell BBC say: ‘We first tink say na thunder, we later hear say na plane crash. We carry canoe go begin find am. We find am till we see am inside di forest, we find am for ova 2 hrs. We no see anytin for dia, we no fit bring anytin come out, we see shoes, we see clothes, we see human flesh and intestines.’ Alexander add say dem notice say di engine don enta water, dem no fit drag am out. ‘We no find any bodi weda na dead or alive, We no know who dey inside di helicopter,’ e tok.
Di Nigerian Navy and oda security agencies don deploy go di area, wia search and rescue operation dey ongoing. Crashes of aeroplane no dey too common for Nigeria, but recently, Nigeria don record some aircraft accidents.
For October 24, 2024, Sikorsky SK76 Helicopter wey Eastwind Aviation operate and wey Nigerian National Petroleum Company (NNPC) charter crash for Atlantic Ocean near Bonny Finima, Port Harcourt. Di helicopter bin dey carry personnel go one oil rig wen e crash, wey kpai eight pipo.
For December, 2023 one helicopter wey belong to di Nigerian Air Force bin crash for Port Harcourt wia all di crew members bin sustain injuries. Di helicopter bin take-off early Friday morning on 1 December heading to Rivers State wit plan for one operation against wetin di force describe as ‘economic saboteurs’.
For August 2023, one aircraft wey belong to di Nigerian Air Force bin crash for Niger State. Tori reveal say di aircraft bin take-off from Kaduna wia e dey go Minna before di crash hapun for one village for Shiroro local govment Niger State.
For July 2023, di news of anoda crash bin comot again as one aircraft wey dem dey use train for di Nigerian Air Force crash for Benue State. Although NAF tok say nobody die for di crash, but two pilots wey dey onboard land hospital sake of di crash. Dat time, dem setup panel to investigate di cause of di crash wey involve a fighter jet belonging to di NAF.
For February 6, 2023, a maritime patrol aircraft crash land for Lagos. Di aircraft bin dey routine flight before e lose tyres wey make am control di landing go Murtala Muhammed International Airport, Lagos.
From anoda report, di minister tok say controllers lost contact with di aircraft at 0813 GMT and could not re-establish communication before dem report say e disappear. Di wreckage later locate near one naval base for di coastal town of Igbokoda. Search and rescue operations dey underway. No immediate confirmation of casualties from di crash. Di crash na one of Nigeria’s worst military aviation accidents in recent years and e likely to intensify scrutiny of flight safety and operational readiness as authorities investigate di cause.
