HomeEntertainmentTemi Ajibade wey be Femi Otedola daughter don born pikin

Temi Ajibade wey be Femi Otedola daughter don born pikin

Actor, entrepreneur, and creative Temi Ajibade wey be di last daughter of Nigerian billionaire Femi Otedola don born pikin.

Temi wey be di wife of Oluwatosin Oluwole Ajibade wey dey popular as Mr Eazi announce di birth of dia pikin for her social media page.

She post on Thursday evening say ‘Before I form you inside womb I don already know you, Bifor dem born you I set you apart’.

She make di post wit plenti foto wia she dey pose wit her baby bump.

Mr Eazi and Temi bin do dia ogbonge wedding for different kontris inside three continents.

And dis pikin na di first grand pikin of Nigeria businessman Femi Otedola.

Di wedding wey nearly break internet hapun for Monaco, France on May 9, 2025 wia dem do di civil wedding.

Dem do Yoruba traditional marriage for Dubai, and di church wedding hapun for Iceland.

Nigerians and dia fans don dey send congratulatory message to di couple already.

Dem neva tok di gender of di pikin wey dem born yet.


Do you have a news tip for NNN? Please email us at editor @ nnn.ng



Samuel Santos
Samuel Santoshttps://nnn.ng/
Samual Santos na reporter for NNN. NNN dey publish hot-hot tori for Nigeria and around di world for naija pidgin language so dat every Nigerian go fit follow national news, no mata dia level of school. NNN dey only publish tori wey be true-true, wey get credibility, wey dem fit verify, wey get authority, and wey dem don investigate well-well.
RELATED ARTICLES
- Advertisment -

Most Popular