Chief Joseph Ebere Ezeokafor, chairman of Jezco Group of Companies wey pipo sabi as Jezco, don finally regain im freedom after e spend several days for custody of im abductors.
Ezeokafor wey be father of popular social media pesin, Jowi Zaza, dem bin abduct am for early hours of Tuesday as e dey go prayer ground for Awka, Anambra State.
The businessman im abduction bin cause plenty wahala for im family, friends, associates and residents of Anambra State.
According to report, im abductors bin contact im family during im captivity, and dem first demand N700 million before dem later increase di demand go N1.5 billion.
But as of di time wey we dey file dis report, details of how dem release Ezeokafor no clear.
E no also know weda dem pay any ransom or where dem release am.
