HomeEntertainmentWizkid and Davido: Wahala Don Gas Again

Wizkid and Davido: Wahala Don Gas Again

For late night for October 1, 2024, na em Wizkid carry him wahala go microblogging platform dem dey call X, post one kind sub wey dey para say, “Beg me! just like …” After him post, e no tey before fans and other X users begin connect the dots say na Davido viral video Wizkid dey yan.

One X user come ask Wizkid, “Abeg, if you no beef @davido your song no go sell ?”, na so Wizkid reply say, “I no dey beef wack niggas! We all sabi say e dey wack! No talent!”

Na so Nigerians begin react, as many frustrate tire for the matter wey no dey finish. Popular OAP Do2dtun talk say, “This na the longest rivalry for Nigerian entertainment. We don tire!”

Social media personality, Daniel Regha, no take am easy with Wizkid. E slam am tayaa, yan say, “Wizkid talk say Davido na “wack” artiste, no get ‘talent’, but e forget say him sef (Wizkid) for no reach wher e dey today without Davido. E dey forget say him wahala with the ‘No talent’ artiste dey help am remain relevant. And lyrically speaking, none strong pass the other.”

Na so Regha still write for another post say, “Wizkid, you no fit dey talk of ‘mids’ when you sef never drop hit song for years; And make you watch your mouth.”

One X user talk say, “Wizkid go dey on him own dey smoke Igbo & dey chook suya but the other guy camp go dey shade and insult am. If him kon decide to talk, na so una go dey shout ‘e start am, e dey find clout, e too troublesome’. Una na hypocrites!!!!!!”

Some social media users dey even call for Wizkid head, “We all agree say make we cancel Wizkid tonight right, enough is enough, make we move.”

Another X user para talk say, “Fan banter, we know as we dey do am as fans. But you and your crooked team don dey do this sh!t for years. Thinking “Wizkid no go talk” as usual, na there una fall hand this time. Obsessed niggga.”

Abullahi Ahmed
Abullahi Ahmedhttps://nnn.ng/
Abdullahi Ahmed na reporter for NNN. NNN dey publish hot-hot tori for Nigeria and around di world for naija pidgin language so dat every Nigerian go fit follow national news, no mata dia level of school. NNN dey only publish tori wey be true-true, wey get credibility, wey dem fit verify, wey get authority, and wey dem don investigate well-well.
RELATED ARTICLES

Most Popular