HomeNewsLamine Yamal Matta Flog for Trading Card Market

Lamine Yamal Matta Flog for Trading Card Market

Lamine Yamal, di 17-year-old Spanish football sensation, dey set everywhere on fire as e dey continue impress fans and collectors with im impressive performances. Recenly, e score one another wonder goal even though hin team lose 4-2 to Osasuna. Dis na di first loss wey dem don get dis season. Yamal no wan slow down as e don ger five goals and five assists for dis season from just nine matches. Last season e do di same tin for 37 matches.

Di young player wey shine for Spain against England for di final tournament, don dey turn to one of di most sought-after football players for trading card market. Di Spaniard don become collectible item for many fans worldwide who dey hunt for hin valuable ‘rookie’ cards.

For one lucky father and son wey dey on holiday for Orlando, Florida, dem fortune shine as dem find one 1/1 autographed Yamal card afta dem pick up one box of Topps Chrome. Father Chris yan Goldin Auction for Instagram say: “We start collect cards about three months ago, and we no believe am when Jake shout, ‘Dad, we get one of one’. Sure enough, di card dey.”

Dem consigned di card to Goldin auctions when dem attend card show for Germany, and after di bidding process end, dem don cash in $122,000 (£91,242) from di sales.

As di trading card market dey hot, another incredible card sell for whopping $103,000 (£77,032). Di trading card market dey boom, so make you rush reach your local card shop – you never sabi wetin you fit pull next.

Rachel Adams
Rachel Adamshttps://nnn.ng/
NNN dey publish hot-hot tori for Nigeria and around di world for naija pidgin language so dat every Nigerian go fit follow national news, no mata dia level of school. NNN dey only publish tori wey be true-true, wey get credibility, wey dem fit verify, wey get authority, and wey dem don investigate well-well.
RELATED ARTICLES

Most Popular