HomeSportsRaphael Varane Don Hang Him Boots, Retire from Ball

Raphael Varane Don Hang Him Boots, Retire from Ball

Raphael Varane, di former Real Madrid and Manchester United defender, don talk say e don retire from football at di age of 31. Dis one happen after e get serious knee injury for him debut for him new club, Como 1907.

Di legendary defender, wey don win 22 major trophies for him 14 years career, comot from di field after only 23 minutes for di match wey dem play for August. Na afta e suffer di injury, dem no add am to Como 1907 Serie A squad for dis season, afta him wakka come di club as free agent afta e commot from Manchester United.

Varane write for Instagram say, “Dem dey always talk say every good thing must get end. For my career, I don face many challenge, rise to meet am, and di things wei people talk say no fit happen, I don do am. Na with big pride and happy belle I dey announce my retire from di game wey we all love.”

Di France World Cup winner don dey struggle with fitness tori sake of di injury wey him dey always get, but him talk say him dey waka comot di game wey e love to dey do another thing for football wey no be to dey play. E go dey take up one non-playing role for Como sake of dis new phase of him life.

Varane start him career for France with club wey dem dey call Lens, before e join Real Madrid for €11 million for 2011. For di club, e spend ten years wey full wit trophies inside Spain. E play 360 matches for Real and na dia e win four Champions League medals and three league titles among oda tins.

For di international level, e win di FIFA World Cup with France for 2018, and e be person wey play every minute for dat tournament under coach Didier Deschamps. E also gather di UFEA Nations League for 2021 wit France national team.

Afta e commot Madrid for 2021, e join Manchester United for £40m. Even though di club dey fight dem own wa hala for dat period, Varane still kuku add FA Cup and League Cup to him collection.

Now, with dis announcement, e talk say “thank you” to football and plan to dey take on new role wey go remove am for pitch but still keep am wey e fit contribute to di game.

Rachel Adams
Rachel Adamshttps://nnn.ng/
NNN dey publish hot-hot tori for Nigeria and around di world for naija pidgin language so dat every Nigerian go fit follow national news, no mata dia level of school. NNN dey only publish tori wey be true-true, wey get credibility, wey dem fit verify, wey get authority, and wey dem don investigate well-well.
RELATED ARTICLES

Most Popular