Nigeria Army don rescue 33 people wey armed men bin kidnap for north-western Zamfara state. Di rescue take place for Tsafe area of Zamfara on Saturday afternoon.
According to di army, dem bin mobilise troops alongside police immediately after dem hear about di abduction. Dem find di kidnappers as dem dey move di hostages to unknown location.
Di gunmen bin flee into di nearby bush after di troops open fire. All di hostages dem recover without any casualties.
Army spokesman Lt-Col Aliyu Danja say e no clear where di abductors dey take di hostages before di troops intercept dem. E add say di army dey try to track di kidnappers.
Danja warn members of di public for di region to remain vigilant and pass relevant information to security forces. Kidnapping by armed groups wey dey hold people for ransom na common thing for parts of north-western Nigeria, and major roads don become target for attack.
Analysts say ransom payments by desperate families, intermediaries, or in some cases Nigerian authorities, don fuel di abductions.
Nigeria security forces don record recent success for rescuing kidnapped victims. On Thursday, di presidency say more dan 300 people wey dem bin abduct for separate attacks for Nigeria don be rescued.
Those wey dem free include 163 people wey dem bin abduct for February for Woro and Nuku communities for Kwara state, where scores die. At least 145 others dem bin take for Niger state.
Di rescue come weeks after 44 pupils and teachers wey dem bin abduct during raid for school for Oyo state bin free after more dan 50 days for captivity.
President Bola Tinubu bin don tok on Wednesday say soldiers go get pay increase up to 80% as government ‘deep appreciation’ for those wey dey battle di nation enormous security threats. Tinubu dey try to curb widespread banditry, kidnappings and violence from various armed groups, including Islamist militants.
Continuing insecurity nationwide don become major political issue ahead of 2027 elections.
