Di National Youth Service Corps (NYSC) don announce say di National Electronic Registration Database (NERD) clearance don bicom compulsory for prospective corps members. Di corps for statement on Monday, 3 August warn say without di NERD clearance, corps members no go eligible for mobilisation for di compulsory one-year service scheme.
“No NERD clearance, No NYSC,” di post tok. Dis informate dey come as di scheme begin mobilisation activities for di 2026 Batch ‘B’ service year. Dem ask institutions and eligible graduates to complete all required documentation bifor di orientation camp, plus make dem get di clearance early.
Di scheme also release fresh guidelines for prospective corps members ahead of dia orientation exercise, wey include warning against late night travels. Di corps also say some corps members wey dem deploy to Lagos and di FCT go dey redeployed to oda states for dia orientation course.
“Some prospective corps members wey dem deploy to Lagos go take dia orientation course for Edo, Ekiti, Kwara, Ondo and Osun camps. Some PCM’s wey dem deploy to FCT go do dia orientation course for Benue, Kano, Kaduna and Nasarawa states,” NYSC tok.
Di National Electronic Registration Database (NERD), wey also known as di Nigeria Education Repository and Databank, na one federal digital system dem dey use store and verify academic records, degrees, plus final-year research projects. Nigeria govment launch am for 2025 to centralize, standardize, and verify academic records across basic, secondary, and tertiary levels.
Di purpose na to fight certificate forgery, stop fragmented record keeping, and support national education planning. NERD clearance slip don bicom compulsory now for all prospective corps members bifor NYSC mobilization. Di initiative na to address key challenges wey dey di education ecosystem.
NYSC no go mobilise any graduate from local or foreign tertiary institutions or issue exemption certificate without prove of NERD compliance. Prospective corps members dey expected to don upload or log dia final-year projects, theses, or dissertations into di national repository and get clearance say e no commit educational fraud. Di clearance serve as proof say your academic report and credentials dey verified.
