×
×

INEC go display preliminary candidate list today

Di Independent National Electoral Commission (INEC) don confirm say dem go display di list of candidates wey political parties submit for presidential and National Assembly elections today, across di whole kontri.

INEC Chairman im Chief Press Secretary and Media Adviser, Adedayo Oketola, tell The Nation say di display na to follow di provisions of di Electoral Act.

Oketola explain say di list wey dem go display no be final list, as di final list go publish on September 12, 2026.

According to am, INEC go publish Form EC9 for public inspection today. Dis Form EC9 contain candidates’ affidavits, credentials, and oda personal particulars wey dem submit.

Dem go display di documents for all INEC state offices and offices for di constituencies. Section 29(3) of di Electoral Act, 2026 don provide for publication of Form EC9 within 21 days of receipt. So dis na to follow di Revised Timetable and Schedule of Activities for di 2027 General Election wey INEC release on February 26, 2026.

However, Oketola yarn say e no correct to call wetin dem dey release as ‘list of candidates’, because political parties still get time to withdraw and replace dia candidates before di final list go come out.

E quote Section 31 of di Electoral Act, 2026: candidates fit withdraw, and political parties fit replace withdrawn candidates 90 days before election. Di last day for withdrawal and replacement for presidential and national assembly election na August 22, 2026.

Di final list of nominated candidates go publish on September 12, 2026, as e dey for Section 32(1) of di Electoral Act, 2026.