Building collapse happun on Sunday midnight into Monday for residential area for Oko Anambra state.
Elite lodge wey be three story hostel dey house plenty students of di Federal Polytechnic Oko before e go down for midnight. Tori be say many of di residents dey sleep wen di incudent happun.
E Neva clear how many casualties dey affected but tori be say some students been dey trapped inside di rubbles wen di building go down. Eye witness for di area say dem hear loud noise before di collapse happen. Dem say dem hear cry of pipo wey dey cry for help from di rubbles.
Anoda eye witness say di house bin dey sink before e finally go down. Some say di landlord bin dey aware say di building dey show crack signs, say him warn students to vacate di house but some no listen.
Di incident happen for period wey be say di Federal Poly no dey in session, na him make plenty pipo no dey affected as plenty students wey dey live dia don travel home as school dey on break.
Due to say di area na local place, emergency agencies no too show face on time wey make locals join hands begin rescue victims from di rubbles. As at time of dis tori excavators still dey push through di rubbles to check for trapped victims and survivors. Though heavy rain dey fall, emergency teams still dey do dia work to ensure say dem save any pesin wey still dey trapped inside.
Our reporter wey visit di location say di pipo for di area believe say more pipo still dey trapped or killed inside di rubbles. Police for di state say dem dey work wit oda emergency agencies don rescue some injured victims and send dem to hospital wia dem dey collect treatment. Videos online show wen dem rescue some injured victims and move dem to hospitals.
Our reporter say emergency work dey dull for dia sake of say na only one excavator dey ground to dig through di rubles of di collapsed building. At about 2pm monday afternoon emergency teams discover di body of one of di victims from di collapsed building and carry am go morgue.
Building collapse na big menace for Nigeria and most Africa kontris as e don lead to loss of plenty lives and destruction of properties worth billions of dollars.