I don meet the leaders of National Youth Council of Nigeria for Akwa Ibom. I use the chance remind our young people make dem focus on their self-development and protect the peace and unity wey we dey enjoy now.
Na why we create Ministry of Youth Development, and we dey invest well-well for programs like DASAC and Ibom LED. These programs go help equip our youths with skills, leadership capacity, and opportunities wey go fit carry dem go far in the future.
As we dey waka towards 2027, I dey urge our young people make dem shun violence and no allow anybody use dem disrupt the peace. Akwa Ibom most continue to grow for unity, stability, and progress. Our government dey committed to support the dreams, talents, and aspirations of our young people.
Do you have a news tip for NNN? Please email us at editor @ nnn.ng

