Some pipo dey use dis flood wahala to point finger, while others dey show support. E be like say na d same government wey dem dey blame, na im still dey try rescue pipo and provide relief.
We go ground, as Deputy Governor Prof Kaletapwa and im team dey work, because we dey focused on action, no time for drama.
About di old Chochi project wey don dey shelve for long—history no dey lie. No be all legacy go last well.
Make we remember say flood no dey respect politics. We too no suppose carry politics for our mind when lives dey at risk.
My heart dey go out to families wey lose loved ones and all d victims wey dey suffer because of dis flood matter.
Do you have a news tip for NNN? Please email us at editor @ nnn.ng

