HomeSportsTransfer News: EPL Clubs Don Prepare for January 2026 Window

Transfer News: EPL Clubs Don Prepare for January 2026 Window

My people! E don reach that time wey every football fan dey yarn about transfer window. Na wetin be dis? All di drama, all di gossip, all di action wey dey happen for di Premier League as dem prepare to open January transfer window.

As di window go open for January 1, 2026, and close for February 2, 2026, every club dey plan wetin dem go do to strengthen dia squad. Some dey look for top players while some just dey check how to sell some players wey no dey fit in anymore.

First, make we talk Arsenal. Dem don busy for summer, and dem no too sabi do plenty business for January. Mikel Arteta don talk say him believe say di current squad fit carry di league title. But we know say injury don msh m wehn no be small. Players like Gabriel and Kai Havertz dey on di sideline, but dem dey scout young talents for Europe, especially players wey go fit enter di squad for di future.

Next, we gatch talk Aston Villa. Dem no expect big signing for di January window because of profitability and sustainability rules don limit wetin dem fit do. But dem don sign 19-year-old winger Alysson from Gremio as development player. Villa gatz keep dem key players if dem wan push for di title.

Manchester City dey ready to finalize di deal for Antoine Semenyo from Bournemouth because dat guy don dey shine like star. His £65m release clause dey call dem, and omo, City don dey position dem self to snatch him from rivals like United and Chelsea.

Brentford dey search for new defensive midfielder because Vitaly Janelt dey leave soon. Dem dey eye Feyenoord’s Quinten Timber. Brighton too dey plan to replace Carlos Baleba as dem dey keep an eye on di market for strikers and defenders.

Burnley, on top of relegation matter, dey look for players wey fit help dem survive as dem prepare for busy window. Chelsea gatz sell deadwood for January; players like Raheem Sterling and Axel Disasi fit find new homes.

Tottenham dey plan di recruitment of fresh attacking players to shake tins up for dem front line. And for di gaffers wey dey at di back, dem wan look for defenders to strengthen dia options.

West Ham dey focused on finding new goalscorer, especially with Niclas Fullkrug likely to gree for AC Milan. Fulham gatz look sharp as dem dey explore new signings to avoid relegation wahala.

As di transfer window dey open shortly, every club don dey ready to make di right moves, either to bring in hot players or shift players wey dey cause wahala for squad. Make we dey holla, as di drama unfold!


Do you have a news tip for NNN? Please email us at editor @ nnn.ng


Samuel Santos
Samuel Santoshttps://nnn.ng/
Samual Santos na reporter for NNN. NNN dey publish hot-hot tori for Nigeria and around di world for naija pidgin language so dat every Nigerian go fit follow national news, no mata dia level of school. NNN dey only publish tori wey be true-true, wey get credibility, wey dem fit verify, wey get authority, and wey dem don investigate well-well.
RELATED ARTICLES
- Advertisment -

Most Popular