×
×

Raya No Dey Hide: I Still Want Play La Liga Before I Retire

Arsenal goalkeeper David Raya don tok say e still get strong desire to test himself for La Liga before im career end.

Di Spain international, wey contract dey run until 2028, still be Mikel Arteta first-choice goalkeeper for Emirates Stadium, but e never rule out say e fit return to im homeland.

Raya yarn dis one when e speak to Marca. ‘Yes, I would love to. I would love to try out La Liga. For now, I’m very happy here, but I would certainly like to experience the Spanish league,’ na wetin e tok. E add say e think La Liga na very competitive league and perhaps, in future, e fit play for Spanish club. ‘I’m Spanish, and I’d love to play there, that’s for sure,’ e talk.

Since e join Arsenal from Brentford, di 31-year-old don establish himself among Premier League most dependable goalkeepers. E don make 114 appearances across all competitions, record 52 clean sheets and concede 89 goals.

Report also tok say e play big part for Arsenal Premier League and Community Shield triumphs last season.