President Bola Tinubu don appoint six new senior officers for di Independent National Electoral Commission (Inec) to fill vacancies wey expiring tenures create, according to one statement from Presidential tok-tok pesin Bayo Onanuga on Friday.
Di six nominees na four new national commissioners and two new resident electoral commissioners. Dem still need to pass through screening by di Nigeria Senate before dia appointment go take effect.
Di announcement come exactly three months before di 2027 general elections, wey Inec timetable say go start on 16 January.
Di national commissioner nominees na Professor Mustapha Aliu for North West, Bashir Muhammed Umar for North Central, Bala Bila wey dem reappoint to continue representing North East, and Oluwatoyin Babalola for South West. Di two resident electoral commissioners na Samuel Akinjide Akinleye for Ekiti State and Zahradden Basiru Sanusi for Jigawa State.
President Tinubu ask di Nigeria Senate to speed up di screening process for di nominated individuals because of di forthcoming elections.
Some Nigerians wey react on social media
