One flight wey leave Dubai go Tel Aviv no reach where e dey go as e divert go Saudi Arabia after fight between di pilots, Israeli officials tell local media.
Di Flydubai plane take off from Dubai International Airport for United Arab Emirates early on Wednesday morning. Flight tracking website Flightradar24 talk say di plane signal emergency code two hours into di journey.
Minutes later, e switch to code wey dem dey use report hijacking, but later dem turn am back to di general emergency signal, Flightradar24 add.
Di Israeli prime minister office say dem no believe say di incident na hijacking.
Passengers tell local media say dem fear for dia lives as di plane start to drop during di incident.
Local media report, citing Israeli defence officials, say dem think say di emergency signal come after altercation between di pilot and co-pilot.
Flight FZ1073 carry around 150 people, most of whom na Israeli. E suppose land for Ben-Gurion Airport but instead e land for Tabuk Airport in northeastern Saudi Arabia.
One Flydubai spokesperson confirm say di flight ‘experienced an incident while en route’, and say updates go dey issued as more details show.
‘Our teams dey work closely with di relevant authorities,’ e add.
Data from Flightradar24 show say di plane do rapid descent over Saudi Arabia, just two hours after take-off. E descend more than 17,000 feet (over 5000 m) in less than two minutes just after 05:21 UTC (06:21 BST).
At 05:40, di flight briefly enter Jordanian airspace before e loop back into Saudi Arabia minutes later, where e then begin im descent for landing.
Di Israeli air force dispatch fighter jets in response to di incident and Prime Minister Benjamin Netanyahu hold urgent consultations on di incident.
